I be Allen Kay wey Sabi!




Lolu's Tori Today.
I be Allen Kay wey Sabi, i dey fair in complexion. I be confirm correct shoe maker wey Sabi work. Na me be the life of the party..I no dey really shy like that Sha. My full name na Omokehinde Allen praise, I rep Jan 11! Capricorn. I dey school for osun state University where i dey study lingua Franka. I dey part 3. I be die hard fan of naija jollof e dey always Sweet my geshi belly. I be straight babe! Soul lover of gospel music.
I geh passion to dey always handcraft nice shoes. I dey talented for that area.
Status? Na olumo rock oh lol!!
I sote love guys wey geh Beard's wey dey neat, con handsome, tall! Wey dark join! And lastly he con dey romantic lol.. you don geh my mumu button be that oh lolss.
I love to dey always rock my low cut with earrings wey Sabi big e dey always gime Babyface. Suya na bae for me con top am with Coca-Cola wey dey chilled e dey always Sweet me. Naija don taya me i no mind if i travel go Paris.
In the next four years i dey see myself as a very successful shoemaker and also a successful  journalist... Lastly a billionaire cos i too like money no be small.

@ loluafrika.

Comments

Popular Posts