Oreofe Sha! On lolu's Tori tonight!
I rep December 29! Capricorn.
I'm an introvert. My school dey for ikire.
I sote weird ikr! lol.
I sote love big clothes. Food na my bae! I love am even thou i still dey small like crayfish. I dey write for blog. loluafrika.blogspot.com .
I podcast sometimes. https://anchor.fm/lolu
My penname na lolu. I geh the name from the movie potato' potaeto
I stammer when angry. I no geh role model. I draw sometimes. Status?? Ino even know I jus dey there jelenke!. E don' Taya me to dey always find love wey no real.
Birth name na 'Grace.
I no geh crush! My heart dey strong giri like olumo rock e no dey hiar word! Buh e be like say Johnny drille dey one Korner of my jenleke heart, hin song dey always totori my geshi heart everynight as i dey sing hin song for mirror dey chop kuli.
I be loner Sha.I fit sleep on top water i too like am. Ha! Amebo na my hobby! I too like gist wey Sabi correct, but i no dey do gbeborun oh..
People say i geh small yansh say my hair dey like rat don chop am for front... E dey always pain me for bodi on top say I con dey tiny like toothpick betti someday i hope say I go dey chubby like orobo coke.
After i don comot for school i wan be a fashion potografer go dey back am up for RADIO' every night as i go dey anchor; love tori programs every evenings with lolu for jams FM, cos i Sabi geh tiny voice wey i like sote too much..lol
I no like may them Sabi notice me when i dey for outside cos i dey always shy.
I no dey look eyeball when i dey talk..e dey always do me electric shock but I fit look your shoe dey smile.
And lastly i be naija babe wey Sabi, ibadan babe to be presciesly..lol.
Na my Tori be that!
@loluafrika
Comments
Post a Comment